Hate, Pt. 2 by Empire Mates Entertainment. (Ft. BasketMouth)
Hate, Pt. 2 by Empire Mates Entertainment. (Ft. BasketMouth)

Hate, Pt. 2

Empire Mates Entertainment. & BasketMouth * Track #12 On Empire Mates State Of Mind

Download "Hate, Pt. 2"

Album Empire Mates State Of Mind

Hate, Pt. 2 by Empire Mates Entertainment. (Ft. BasketMouth)

Performed by
Empire Mates Entertainment.BasketMouth

Hate, Pt. 2 Annotated

Oya, let's go, let's go, let's go
Boy you talk say you hate E.M.E
No be E.M.E music you dey listen to for this one?
Na E.M.E music be this
Yes now
Ehn, na my sister go don put am inside
I dey try check the thing since sef
Why you no go check am?
The CD player don spoil
That’s why I just leave am there
Okay, but you dey nod your head to the music
I just say catch you now you dey nod your head
I no nod my head
I get neck problem
My doctor say make I dey nod head
Every time wey the thing dey pain me
Say thе pain go dey go
Men
But you’re nodding your hеad to the beat
The beat?
Yes
No him say make I dey nod am to any beat wey I hear
Say he go make dey rhythm
Okay, why you no off the radio?
Me? Off the radio?
Look, see ehn, no dey ask me
No dey ask me this kind thing
As I dey hear this song
I dey hear this song so
I wan don go jam person now
So you dey annoy me
Because of music you go jam person
I hate this E.M.E people
I hate them
I no just like them
You sef why you dey ask me question?
Why you dey ask me question?
You know what?
I wan
You know, comot for my motor
Comot for my motor
Comot from this motor
Oh boy na me na
Na me get this motor
Na your motor?
Yes!
Ehn ehn
You know what
I wan comot
I wan commot from this motor
Just pack
In short, na me dey drive sef
Make I pack

Your Gateway to High-Quality MP3, FLAC and Lyrics
DownloadMP3FLAC.com